Songtexte.com Drucklogo

20 10 20 Songtext
von Burna Boy

20 10 20 Songtext

Shey you never hear?
About the things wey happen there
Abi your eye never clear
Mankind so wicked
I talk about my government
Open your mind and your ears

Wetin happen?
Shey na jazz o
Make my people suffer, suffer
All their yanshes don dey open
Everythin′ don scatter, scatter

Twentieth of October, 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water o, water runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

The Chief of Staff, the Commander
And the Army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo ijoba


All your atrocities
All of your corner corner
Make all the deadbody
Disturb you for your dreams

The money wey you thief yapa for your aza
You don turn our graduates to common beggars
All the book them go no matter
'Cause you no go get job if you no know Godfather

The Chief of Staff, the Commander
And the Army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo ijoba

All your atrocities
All of your corner, corner
Make all the deadbody
Disturb you for your dream

Twentieth of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water o, water runaway my eyes
Nothin′ you go talk wey go justify the case of their murder


We give them many chances
Them fail my people
And When we cry for justice
Them kill my people
Walahi all of you
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths
Wey die for tollgate

Ah, ay, ah, ay, water runaway my eye
Ah, ay, ah, ay, water runaway my eye

(Shoot! "Let them shoot, let them shoot")
(No problem, no problem)
("Everyone sit down, sit down, sit down")
(That is why, that is why they offed the light, yes!)
(And this one survived, other people, ah)
(They've been shot and killed)

Twentieth October 2020

Songtext kommentieren

Log dich ein um einen Eintrag zu schreiben.
Schreibe den ersten Kommentar!

Quiz
Welcher Song ist nicht von Robbie Williams?

Fans

»20 10 20« gefällt bisher niemandem.